Advertisement

Why E Be Say

Album cover art for "Why E Be Say" by P-Square

P-Square - Pop

Why E Be Say

0 Plays

View Artist

Lyrics

[Intro: Rudeboy, Mr. P] Ai! Ooh, yeah, eh (Ooh yeah, eh) Yeah, ai, no, ooh Chai! I don die, yeah (I don die, yeah) Ooh, yeah (Eh, ai) Why e be say, the wrong thing be say But the right thing be say Ai [Verse 1] (Why e be say) The way that we are living are not supposed to be the way you and I are still living (Why e be say) The leaders just dey chop money dey go because they think say we all no dey see them (Why e be say) They took away our rights and make silly promises, they want us to believe them Why e be say some people too dey lie (Lie) Why e be say some people no dey try, ai Corruption na frustration wey dey bring back condition is what we are feeling (Why e be say) Some people just sit down, dey just dey look Day and night, they be staring at the ceiling (Why e be say) They look into our eyes and tell us say e go better while the baggers still stealing (Eh) Why e be say some people too dey lie (Lie) Why e be say some people no dey try I don die, yeah [Chorus] Why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (Na big lie eh) The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say, wetin we go say The right thing be say we supposed to do Wetin we go do or say, wetin wey we go say Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah eh [Verse 2] (The wrong thing be say) We dey dey fight, to try to kill each other But we supposed to love one another (The wrong thing be say) Because them no dey go worship together A brother try to kill a fellow brother (The wrong thing be say) Even as we still there dey suffer We still dey try to dey love one another Why, my brother, why you dey chook eye for your brother? The leaders dey dey chop their bread and butter In our society, we no dey try make we live like one family What a tragedy, with our wealth we are still living in poverty (The wrong thing be say) As poor man dey holla (Chineke) The rich ones dey hammer (Yes o) The wrong thing be say things dey scatter The wrong thing be say we no dey bother I don die eh [Chorus] Why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (na big lie eh) The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say wetin wey we go say The right thing be say we supposed to do Wetin we go do or say wetin wey we go say Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah eh Why e be say now, why e be say See the wrong thing be say But the right thing, the right thing, the right thing, the right thing be say [Verse 3] All man supposed to get money, all man supposed to dey jolly (The right thing be say) All man supposed to get motor, all man supposed to dey kolo (The right thing be say) We supposed to get energy and power, supposed to get better rod and mortar eh But why e be say some people no dey try Why e be say some people too dey lie I don die eh [Chorus] Why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (na big lie eh) The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say wetin wey we go say The right thing be say we supposed to do Wetin we go do or say wetin wey we go say Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah Why e be say now, why e be say anytime we wan do wetin we go do or say wetin wey we go say (the wrong thing be say) The wrong thing be say them no want make we dey do wetin we go do or say wetin wey we go say The right thing be say we supposed to do Wetin we go do or say wetin wey we go say Why e be say, the wrong thing be say but the right thing be say eh ah eh ah [Outro] Why e be say Why e be say Oh oh

Rate this song

Rate this song

0/5.0 - 0 Ratings

5
0.0% (0)
4
0.0% (0)
3
0.0% (0)
2
0.0% (0)
1
0.0% (0)

Loading comments...

Credits

Writers
  • P-Square